1 God hate pipol wey dey play wayo,
2 E good to dey honest,
3 Na trut dey guide yu if yu dey good;
4 Wen God won judge yu, yor money and propaty nor go fit help yu,
5 Pesin wey dey good dey always do good tins,
6 Raitiousness dey save doz wey dey tok trut,
7 Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem,
8 Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol;
9 Doz wey nor know God, wetin dem dey tok, fit distroy pesin,
10 Just as pipol dey happy wen good pesin dey prosper,
11 E go betta for any town wey raitious pipol bless;
12 E too tok bad about odas, but if yu get sense,
13 Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret,
14 Any nashon wey nor get who dey guide am, go fall,
15 Trobol dey follow who promise to pay di money wey strenja owe.
16 Dem dey respet woman wey dey respet pipol,
17 Pesin wey good dey gain favor for ensef;
18 Wiked pipol nor get gain for anytin,
19 Anybody wey ready to live rite, go get life;
20 God hate pipol wey get bad mind,
21 Make yu know sey God go ponish wiked pipol;
22 Fine woman wey nor get sense,
23 Wetin good pipol wont, dey bring good result;
24 Wen pipol give out dia money, dem dey get more;
25 Make yu dey give and yu go prosper;
26 Pipol go curse di pesin wey store en korn
27 Dem go respet yu if yu get good mind;
28 Doz wey trust dia propaty,
29 Pesin wey bring trobol kom meet en family,
30 Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life,
31 Doz wey good, dey get dia reward for dis world,