1 My pikin, make yu listin to my wisdom
2 Den yu go know how to bihave well and di way yu go dey tok,
3 Anoda man wife lip fit sweet like honey
4 but wen evritin don finish,
5 Di woman go take yu go where dead body dey,
6 Di woman nor dey tink about di road wey dey save;
7 But my pikin, make yu listin to mi
8 Run from dat kind woman;
9 If yu follow am, nobody go respet yu again
10 Yes! Strenjas go take all yor propaty
11 Den for di end, yu go kry with pains
12 Den yu go sey, “Why I nor follow wetin dem tish mi?
13 Why I nor obey my tishas!
14 Naw, na wons
15 Just as yu go take wota from yor own well,
16 Make yu nor just bi like river
17 Make yu keep yorsef for yor wife alone
18 So always dey happy with yor wife
19 bikos e fine and dey honbol like deer.
20 My pikin, why yu go-go give yor love to anoda woman?
21 God dey si evritin wey yu dey do
22 Wiked man sins na trap,
23 E go die bikos e nor fit kontrol ensef.