1 Na di words wey King Lemuel mama tish am, bi dis.
2 My pikin wey I born;
3 make yu nor waste yor strent dey follow wimen;
4 Lemuel, my pikin!
5 Bikos wen dem drink,
6 Strong drink na for pipol wey dey won die
7 So allow dem drink forget dia poverty
8 Make yu tok for doz wey nor fit tok for demsef;
9 Yes! Tok well for doz wey dem dey opress and for poor pipol,
10 Who go fit find wife wey get good karata?
11 En husband go trust am,
12 Na only good tins e go bring for en husband evritime
13 E dey always dey do business;
14 E bi like ship for river,
15 E dey kwik wake-up for morning to make food for en family
16 E go-go look land kon buy am and e go use di money wey e get,
17 E get pawa, dey strong
18 E know di value for evritin wey e dey make
19 Na only en dey use tread
20 E dey always give tins to poor pipol
21 E nor dey worry if kold dey,
22 Na en dey make en own bed shit
23 Pipol know en husband well-well and dem dey respet am,
24 E dey make klot and belt
25 E dey strong; dem dey respet am
26 E dey tok with betta sense
27 E always dey busy
28 En shidren value am and dem dey tank en and en husband.
29 En husband go sey, “Many wimen na good wifes to dia husband,
30 Gold dey deceive pipol and beauti dey disappear,
31 Make una reward am for evritin wey e dey do