1 Na King David pikin, Solomon, wey dey rule Jerusalem, rite dis words.
2 Di tisha sey, “Evritin dey yuzles!
3 Wetin pipol dey gain from all di hard work
4 Wen one generashon kom, di one wey dey before go-go,
5 Di sun dey raiz-up and down,
6 Breeze dey blow go sout and nort.
7 Even as wota dey flow enter sea rish,
8 All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi:
9 Wetin don happen before, go happen again
10 E get anytin for dis world wey fit make pesin sey,
11 Wi nor dey remember wetin don happen before and for di next generashon,
12 Mi wey dey tish una, I bi king for Israel and I stay for Jerusalem
13 and I make up my mind to search and undastand evritin wey pipol don do for dis world. But I kon si sey, God don really give us betta work to do for dis world.
14 As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.
15 Wetin bend, wi nor go fit strait am
16 Den I tell mysef, “Na mi wise pass evry oda king wey don rule for Jerusalem before mi. Bikos I get wisdom and undastandin wey dem nor get.”
17 So I kon gri to find out wetin wisdom, madness and foolishness bi. But e klear sey, na breeze I just dey porshu,
18 bikos di more I dey find out,