1 Dis na wetin Agur wey bi Jakeh pikin tell Itiel, Ukal and Itiel:
2 “I dey foolish pass any oda man
3 I neva learn how to get wisdom
4 Who don go heaven kom back?
5 “Evritin wey God tok, dey korrect. E dey guide evribody wey kom meet am make E protet dem.
6 Make yu nor add join God word, if not, E go curse and koll yu lie-lie pesin.
7 “My God, I beg Yu for two tins and make Yu give dem to mi, before I die.
8 Di first one na: Help mi make I nor dey lie and deceive pipol and di sekond one na, make Yu nor make mi too rish or too poor! Make yu give mi di tins wey go rish mi use.
9 Bikos if I too get money, I fit deny Yu sey, ‘Who bi God?’ And if I too poor, I go fit go tif kon bring shame for yor holy name.
10 “Make yu nor ever spoil worker give en oga, bikos if di pesin curse yu, di curse go follow yu forever.
11 “Some pipol dey curse dia papa and some nor dey tank dia mama.
12 “Dem bilive sey dem dey good for dia own eye, but dem dirty pass rag.
13 “Dem dey karry body as dem dey waka, so dat pipol go dey look dem anyhow.
14 “Dia tit bi like swod and dia mout sharp like knife. Dem dey distroy poor pipol komot from dis eart and pipol wey nor get food to chop, dem dey kill dem trowey.
15 “Worm get two side wey dey sey: ‘Give mi, Give mi.’
16 “Grave,
17 “Di mout wey dey laf en papa and nor dey obey en mama kommand, bird from valley go plok am komot and vulture go chop am finish.
18 “E get four tins wey dey hard mi well-well to undastand and dem bi:
19 “ ‘How eagle take dey fly high-high for sky?
20 “Ashawo woman wey sleep with anoda man fit kill pesin, afta e go klean en mout kon sey, ‘Na wish bad tin I do?’
21 “E get four tins wey dey shake di eart and make pipol fear and dem bi:
22 “ ‘Savant wey turn to king;
23 woman wey pipol nor like wey kon marry
24 “E get four tins for eart wey small, but dem wise well-well and dem bi:
25 “ ‘Ants; dem nor strong,
26 Even small animals wey dey stay for rock,
27 Lokust; dem nor get king,
28 Lizard, dem dey eazy to katch,
29 “E get four tins wey dey waka with pride and dem bi:
30 “ ‘Lion wey bi animals king wey
31 Man fawol and man goat
32 “If yu don do foolish tins bikos yu dey proud or dey plan evil, make yu kover yor mout with shame.
33 Just as cream dey bring butter wen dem shake am and nose wey dem nak dey bring blood, na so too, to make pesin vex, dey kause wahala.”