1 My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu
2 Wetin I tish yu
3 So make yu always get faith and dey honbol;
4 If yu do like dat,
5 Make yu always dey trust God with all yor heart,
6 Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do,
7 Nor tink sey yu wise pass di way yu bi,
8 If yu do like dis,
9 Honor God with yor money
10 If yu do so, korn go full yor store
11 My pikin, if God korrect yu,
12 Bikos God dey korrect only di pipol wey E love,
13 Pesin wey wise and get undastandin,
14 Undastandin get gain pass silva
15 Wisdom get value pass gold
16 E go give yu long life,
17 E go still make yor life sweet
18 Wisdom na tree wey dey give life
19 God kreate di eart with en wisdom
20 Na en wisdom make river dey flow
21 So my pikin, whole di wisdom and undastandin wey yu get well
22 Dem go make yu live sweet and happy life.
23 Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do
24 Fear nor go katch yu wen yu dey sleep
25 Yu nor nid to worry about wahala wey go just happen,
26 God go save yu
27 Anytime wey yu fit,
28 Nor ever tell yor neighbour make e wait till tumoro,
29 Nor ever plan bad against yor neighbour,
30 Nor argue with pesin just bikos yu won argue,
31 Nor jealous or bigin bihave like pipol
32 bikos God hate pipol wey dey do evil,
33 God don curse wiked pipol house,
34 God nor get wetin E won do with proud pipol,
35 Pipol wey wise go get good name,