Provérbios 2

PCM

1 My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu

2 Listin to wetin dey wise

3 Yes, make yu beg for wisdom

4 Find am well-well,

5 If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God

6 Na God dey give wisdom!

7 E dey help and protet

8 E dey protet pipol wey dey trit odas well

9 So, if yu listin to wetin I dey tok;

10 Yu go dey wise and di sense wey yu get

11 Di sense and undastandin wey yu go get,

12 Wisdom go save yu from wiked pipol;

13 From pipol wey live good life before

14 and dem dey happy to do

15 E go still save yu from pipol

16 from ashawo wimen wey get sweet mout

17 Dis kind woman nor dey faithful to en husband

18 If yu go en house,

19 Nobody wey go visit am, dey kom back alive.

20 So, make yu follow wetin good pipol dey do,

21 Raitious pipol and doz wey get respet

22 But just as dem dey rut plant komot for groun,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado