1 Solomon, David pikin wey bi king for Israel, na-im rite all dis wise word.
2 E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise.
3 Dis words go tish una how to live betta life,
4 Dis words fit make pesin wey nor know anytin get sense
5 Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more
6 so dat dem go fit undastand proverbs, parabols
7 For yu to get wisdom, yu most fear God,
8 My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu
9 bikos wetin dem dey tish yu go bi like betta shain for yor neck
10 My pikin, wen sinnas tempt yu,
11 If dem tell yu sey, “Kom make wi go kill pesin!
12 If dem sey, “Even doh di pipol dey alive and okay naw,
13 Den wi go si plenty good tins
14 So, kom join us
15 My pikin, make yu nor follow dat kind pipol
16 Bikos dem dey enjoy to do bad tin
17 E nor dey good to set trap
18 But pipol wey dey do like dat,
19 Dis na wetin dey happen to pipol
20 Wisdom dey koll pipol
21 e dey shaut dey koll dem
22 Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool?
23 How I wish una go gri listin,
24 I dey koll and invite una since,
25 Una nor gri take my advise
26 So, I go laf una wen una enter trobol
27 Dat time, trobol go kom meet una like heavy breeze
28 Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa.
29 Una nor ever get wetin to do with wisdom
30 Una nor wont my advise
31 So, una go get wetin fit una and wetin una do,
32 Pipol wey nor know anytin,
33 But anybody wey listin to mi,