1 Wiked pesin dey run wen nobody dey porshu am,
2 Wen pipol dey always sin,
3 Poor man wey dey opress oda poor pipol,
4 So pesin wey nor dey respet di law, dey praiz wiked pipol,
5 Evil pipol nor know wetin korrect judgement mean,
6 E betta to dey poor and honest,
7 Yong man wey dey obey di law get sense.
8 If yu get money from intrest wey yu dey kollect,
9 If yu nor dey obey di law,
10 If yu deceive honest pesin kon make am do bad tins,
11 Rish pipol dey always tink sey dem wise,
12 Wen good pipol dey rule, evribody dey happy,
13 Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin.
14 If yu always dey obey God, happiness go follow yu,
15 Just as pipol dey fear hongry lion and wiked bear,
16 Ruler wey nor get betta sense, go rule with wikedness.
17 Pesin wey kill anoda pesin dey kwik-kwik dig en own grave,
18 Dey always tok trut and e go save yu,
19 Farmer wey dey work hard, get plenty food to chop,
20 Pesin wey dey tok trut, go live betta and happy life,
21 To dey judge anyhow nor good,
22 Pesin wey get long-trot dey always hurry to get money,
23 If yu korrect pesin,
24 Pesin wey tink sey e nor bad to tif from en papa and mama,
25 To get long-trot dey only kause trobol,
26 Pesin wey feel sey na only en know di korrect tin, na big fool,
27 Make yu dey always give tins to poor pipol and yu nor go ever lack,
28 Pipol dey hide wen wiked pesin dey rule,