1 E betta make pesin dey poor and get good karata,
2 To wont betta life without wisdom nor good;
3 Wen pesin distroy ensef with di stupid tins wey e do,
4 Rish pipol dey always get new friends,
5 If yu bi lie-lie witness, dem go ponish yu
6 Evribody dey try make dem gain favor for rish pesin front,
7 Man wey nor get money, nor get value for en brodas hand, even en friends dey run from am.
8 Do good to yorsef kon learn evritin wey yu fit learn;
9 Anybody wey tok lie for wetin e nor know, nor go fit eskape ponishment
10 Make foolish pipol nor dey spend money anyhow
11 If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa.
12 Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut,
13 Foolish shidren fit distroy dia papa and mama,
14 Pesin fit inherit en papa and mama propaty,
15 If yu like, dey lazy and dey sleep anyhow,
16 Keep God kommandment and yu go get long life;
17 Wen yu give sometin to poor pipol,
18 Train yor pikin well wen dem still dey yong to learn;
19 If pesin get hot tempa, make e ready for anytin wey go happen,
20 If yu dey listin to advise and dey ready to learn,
21 Pipol fit plan difren-difren tins,
22 Wetin important pass na to dey loyal.
23 Obey God and yu go get long life;
24 Some pipol too lazy to put food
25 E good make dem ponish who dey karry body up,
26 Na only pesin wey nor get shame go trit en papa anyhow
27 My pikin, if yu stop to learn,
28 If witness for kourt dey tok wetin e nor si,
29 Just as dem dey beat foolish pesin,