1 Pipol wey nor kare about odas, dey tink only about demsef;
2 Foolish pesin nor dey worry weda e undastand sometin or not;
3 Na sin and shame dey waka togeda.
4 Word wey pesin tok fit give yu sense wey deep like sea
5 E nor good to favor who do bad,
6 Wen foolish pesin start to argue,
7 Foolish pesin word dey distroy am;
8 To do aproko, dey good well-well for mout wen yu dey tok am,
9 Lazy pesin bad like pesin
10 God name na strong place to hide put,
11 Rish pipol dey tink sey di propaty wey dem get go protet dem
12 Respet dey kom before honor;
13 Make yu dey listin well before yu ansa,
14 Di mind to live fit enkourage pesin wen e dey sick,
15 Wise pesin dey always look for knowledge
16 If yu won go meet important pesin,
17 Di first pesin to tok for kourt dey always dey rite,
18 If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt,
19 To make peace with yor broda wey yu offend,
20 Wen yu tok betta words, belle go sweet yu,
21 Wetin yu tok fit save or distroy yor life.
22 Man wey find good woman kon marry am,
23 Poor man dey honbol ensef as e dey tok,
24 Friendship if put yu for trobol,