1 Good ansa dey end vexnashon,
2 Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well,
3 God dey wosh evriwhere,
4 Gentol word na tree wey dey give life,
5 Na only fool nor dey listin to en mama and papa word;
6 Pipol wey dey fear God, good tins dey always full dia house,
7 Na good advise dey kom out from wise pipol mout;
8 God hate wiked pipol sakrifice,
9 God nor like evritin wey wiked pipol dey do,
10 Anybody wey nor gri do wetin dey rite, go sofa well-well
11 Even Deat and Distroshon nor get sekret for where God dey,
12 Doz wey dey laf pipol nor dey like korreshon,
13 Pipol dey smile wen dem dey happy,
14 Wise pipol dey hongry to learn,
15 Pipol wey get heavy heart, get plenty trobol;
16 E betta to get small propaty and still dey fear God,
17 E betta to chop vegitabol with pipol wey yu love,
18 Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight;
19 If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu,
20 Shidren wey get sense dey always bring joy to dia papa;
21 Foolishness dey make doz wey nor get sense happy;
22 Plans dey spoil wen good advise nor dey;
23 Evribody dey like good ansa,
24 Wise pipol dey waka for di road wey dey lead to life
25 God dey skata proud pipol house,
26 God hate evil plans,
27 Long-trot dey kill pesin family finish,
28 Doz wey dey fear God, dey tink before dem tok;
29 God dey far from wiked pipol,
30 Happiness dey bring joy to pesin heart
31 If yu listin well wen pipol dey korrect yu,
32 If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do;
33 To fear God, dey bring wisdom