1 Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word,
2 Wise word go put betta food for yor tabol,
3 Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life,
4 Lazy pipol won get plenty,
5 Doz wey dey fear God nor like lie;
6 Na God dey guide innocent pipol,
7 Poor pipol dey bihave like sey dem get money,
8 Rish pipol fit pay anytin for dia life,
9 Doz wey dey fear God, na lite and joy full dia body,
10 To dey karry body up, dey kause wahala,
11 Money wey pesin play wayo take get kwik-kwik, dey disappear,
12 Wen wetin pesin hope for nor kwik rish en hand, di heart go sick,
13 Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol,
14 Wise pipol word bi like wota wey dey give life
15 Dem dey respet pesin wey get sense,
16 Wise pipol dey tink before dem do anytin,
17 Na manaja wey nor get sense dey enter trobol,
18 If yu vex sey pipol dey korrect yu,
19 If pesin get wetin e wont, e dey sweet am well-well,
20 Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too;
21 Doz wey dey like to sin, na trobol dey porshu dem,
22 Good pipol dey leave propaty for dia grand-shidren,
23 Poor pesin farm fit produce many food,
24 Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem.
25 Doz wey dey fear God, go get enough food to chop,