1 “Israel pipol, make una stop to celebrate una festival
2 But very soon, una nor go get enough korn to chop
3 Israel pipol nor go stay for God land again,
4 Dem nor go fit offa wine ofrin or sakrifice give God for der.
5 So na wetin una go do wen festival time rish?
6 Even if dem eskape distroshon for Assyria,
7 Di time to ponish Israel don rish;
8 Na di profet dey wosh ova Israel for God.
9 Just as dem sin for Gibeah,
10 God sey,
11 Efraim greatness go fly komot like bird
12 Even if dem born, I go kill di pikin.
13 Na for my present Israel pipol grow
14 Oga God, na wetin I won sey make Yu do to dis pipol?
15 So God sey,
16 Efraim pipol go bi like plant wey en rut don dry
17 God wey I dey serve go rijet en pipol,