1 Before-before, wen Efraim pipol dey tok,
2 Dem still dey sin and woship juju wey dem make
3 So just as dew dey vanish for morning,
4 God sey,
5 Wen una dey dry land wey nor get anytin,
6 But naw wen una enter betta land, una don dey okay;
7 So, I go attack una like lion.
8 I go attack una like bear wey en pikin lost
9 Israel pipol, mi wey bi una only helpa
10 Una dey ask for king and leaders;
11 Na mi vex give una kings
12 I don gada Efraim pipol sin kon keep am
13 Israel get shance to live,
14 I nor go save dis pipol from grave
15 Even doh Israel dey grow like betta grass,
16 I go ponish Samaria pipol,