Números 22
PCM vs NVI
1 Israel pipol kon travel go Moab for Jordan River for di oda side for Jeriko.
1 Os israelitas partiram e acamparam nas campinas de Moabe, para além do Jordão, perto de Jericó.
2 Balak wey Zippor born kon si all wetin Israel pipol don do to Amor pipol.
2 Balaque, filho de Zipor, viu tudo o que Israel tinha feito aos amorreus,
3 So Moab pipol kon dey fear, bikos Israel pipol plenty.
3 e Moabe teve muito medo do povo, porque era muita gente. Moabe teve pavor dos israelitas.
4 Den Moab pipol tell di eldas for Midian sey, “Dis plenty pipol go kon distroy evritin wey wi get, just as melu take dey chop grass for field.”
4 Então os moabitas disseram aos líderes de Midiã: "Essa multidão devorará tudo o que há ao nosso redor, como o boi devora o capim do pasto". Balaque, filho de Zipor, rei de Moabe naquela época,
5 kon send messenjas go koll Balaam wey Beor born for Petor, wey dey near di river for en town sey,
5 enviou mensageiros para chamar Balaão, filho de Beor, que estava em Petor, perto do Rio, em sua terra natal. A mensagem de Balaque dizia: "Um povo que saiu do Egito cobre a face da terra e se estabeleceu perto de mim.
6 So, I beg make yu kom help mi curse dis nashon, bikos dem too get pawa pass mi. May bi I go defeat and drive dem komot from di land. Bikos I know sey anybody wey yu bless, blessing go follow am and anybody wey yu curse, curse go follow am.”
6 Venha agora lançar uma maldição contra ele, pois é forte demais para mim. Talvez então eu tenha condições de derrotá-lo e de expulsá-lo da terra. Pois sei que quem você abençoa é abençoado, e quem você amaldiçoa é amaldiçoado".
7 So di eldas for Moab and Midian kon karry di curse money go meet Balaam. Dem meet Balaam kon tell am wetin Balak tok.
7 Os líderes de Moabe e os de Midiã partiram, levando consigo o preço para os encantamentos mágicos. Quando chegaram, comunicaram a Balaão o que Balaque tinha dito.
8 Balaam ansa dem, “Make una stay here dis nite and I go tell una anytin wey God tell mi.” So di eldas for Moab kon stay with Balaam.
8 Disse-lhes Balaão: "Passem a noite aqui, e eu lhes trarei a resposta que o Senhor me der". E os líderes moabitas ficaram com ele.
9 God kom meet and ask Balaam, “Dis men wey dey with yu, na who dem bi?”
9 Deus veio a Balaão e lhe perguntou: "Quem são esses homens que estão com você? "
10 Balaam ansa, “Balak wey Zippor born, wey bi di king for Moab, naim send dem kom meet mi sey,
10 Balaão respondeu a Deus: "Balaque, filho de Zipor, rei de Moabe, enviou-me esta mensagem:
11 ‘Si! One nashon don kom out from Egypt and dem plenty well-well for di eart. So make yu kom help mi curse dem; may bi I go fit defeat and drive dem komot from here.’ ”
11 ‘Um povo que saiu do Egito cobre a face da terra. Venha agora lançar uma maldição contra ele. Talvez então eu tenha condições de derrotá-lo e de expulsá-lo’ ".
12 But God tell Balaam, “Make yu nor follow dem go and make yu nor curse di pipol, bikos I don bless dem.”
12 Mas Deus disse a Balaão: "Não vá com eles. Você não poderá amaldiçoar este povo, porque é povo abençoado".
13 So Balaam get up for morning and e tell di prince dem wey Balak send sey, “Make una go una land, bikos God sey make I nor follow una.”
13 Na manhã seguinte Balaão se levantou e disse aos líderes de Balaque: "Voltem para a sua terra, pois o Senhor não permitiu que eu os acompanhe".
14 So di prince dem go back kon tell Balak sey, “Balaam nor gri follow us kom.”
14 Os líderes moabitas voltaram a Balaque e lhe disseram: "Balaão recusou-se a acompanhar-nos".
15 Balak kon send some oda ofisas go again, wey plenty and dey important pass di first ones.
15 Balaque enviou outros líderes, em maior número e mais importantes do que os primeiros.
16 Dem go meet Balaam kon tell am,
16 Eles foram a Balaão e lhe disseram: "Assim diz Balaque, filho de Zipor: Que nada o impeça de vir a mim,
17 I go pay yu well and I go do anytin wey yu tok. Abeg make yu kom help mi curse dis pipol.’ ”
17 porque o recompensarei generosamente e farei tudo o que você me disser. Venha, por favor, e lance para mim uma maldição contra este povo".
18 Balaam ansa, “Even if Balak give mi all di silva and gold wey dey en palis, I nor go fit disobey di Oga my God kommand, even if na for small matter.
18 Balaão, porém, respondeu aos conselheiros de Balaque: "Mesmo que Balaque me desse o seu palácio cheio de prata e de ouro, eu não poderia fazer coisa alguma, grande ou pequena, que vá além da ordem do Senhor meu Deus.
19 But I dey beg make una stay dis nite, just as di oda pipol stay, make I si if God go tok anoda tin.”
19 Agora, fiquem também vocês aqui esta noite, e eu descobrirei o que mais o Senhor tem para dizer-me".
20 Dat nite God appear to Balaam kon tell am, “If dis men sey make yu follow dem, ready make yu follow dem, but na only wetin I tell yu, na-im yu go do.”
20 Naquela noite Deus veio a Balaão e lhe disse: "Visto que esses homens vieram chamá-lo, vá com eles, mas faça apenas o que eu lhe disser".
21 So di next day for morning, Balaam enter en donkey kon follow di prince dem from Moab.
21 Balaão levantou-se pela manhã, pôs a sela sobre a sua jumenta e foi com os líderes de Moabe.
22 Den God vex sey Balaam follow dem, so God angel kon stand for road to stop am. Naw, Balaam dey drive di donkey and en two savants dey with am.
22 Mas acendeu-se a ira de Deus quando ele foi, e o anjo do Senhor pôs-se no caminho para impedi-lo de prosseguir. Balaão ia montado em sua jumenta, e seus dois servos o acompanhavam.
23 Den di donkey si God angel as e stand for di road with swod for en hand, so di donkey turn face di field. But Balaam beat di donkey, so dat e go turn face road.
23 Quando a jumenta viu o anjo do Senhor parado no caminho, empunhando uma espada, saiu do caminho e foi-se pelo campo. Balaão bateu nela para fazê-la voltar ao caminho.
24 Den God angel stand for where vineyard dey and wall dey for di two side.
24 Então o anjo do Senhor se pôs num caminho estreito entre duas vinhas, com muros dos dois lados.
25 Wen di donkey si God angel, e waka near di wall kon press Balaam leg against am. Den Balaam beat am again.
25 Quando a jumenta viu o anjo do Senhor, encostou-se no muro, apertando o pé de Balaão contra ele. Por isso ele bateu nela de novo.
26 God angel go front kon stand for one small place, where road nor dey to turn go rite or go left.
26 O anjo do Senhor foi adiante e se colocou num lugar estreito, e não havia espaço para desviar, nem para a direita nem para a esquerda.
27 Wen di donkey si God angel again, e kon lie down for groun. Den Balaam vex kon beat di am with en stik.
27 Quando a jumenta viu o anjo do Senhor, deitou-se debaixo de Balaão. Acendeu-se a ira de Balaão, que bateu nela com a sua vara.
28 So God open di donkey mout and di donkey tell Balaam, “Wetin I do yu wey make yu dey beat mi so? Yu don beat mi three times!”
28 Então o Senhor abriu a boca da jumenta, e ela disse a Balaão: "Que foi que eu lhe fiz, para você bater em mim três vezes? "
29 Balaam ansa di donkey, “Na bikos yu make mi look like fool: if to sey I get swod for my hand, I for don kill yu naw.”
29 Balaão respondeu à jumenta: "Você me fez de tolo! Quem dera eu tivesse uma espada na mão; eu a mataria agora mesmo".
30 Di donkey ansa, “Nor bi mi bi di donkey wey yu dey ride since kon rish today? I don ever trit yu like dis?”
30 Mas a jumenta disse a Balaão: "Não sou sua jumenta, que você sempre montou até o dia de hoje? Tenho eu o costume de fazer isso com você? " "Não", disse ele.
31 Den God open Balaam eye and e si God angel as e stand for di road with swod for en hand; so e kon fall face groun.
31 Então o Senhor abriu os olhos de Balaão, e ele viu o anjo do Senhor parado no caminho, empunhando a sua espada. Então Balaão inclinou-se e prostrou-se, rosto em terra.
32 God angel kon tell am, “Wetin make yu beat dis donkey three times? Si, I kom here kon stop yu, bikos wetin yu dey do, I nor like am.
32 E o anjo do Senhor lhe perguntou: "Por que você bateu três vezes em sua jumenta? Eu vim aqui para impedi-lo de prosseguir porque o seu caminho me desagrada.
33 Di donkey si mi kon turn from mi three times. If to sey e nor turn from mi, I for kill yu leave di donkey.”
33 A jumenta me viu e se afastou de mim por três vezes. Se ela não se afastasse a esta altura eu certamente o teria matado; mas a ela eu teria poupado".
34 Balaam kon tell God angel, “I don sin. I nor know sey yu stand against mi for di road. So if wetin I dey won go do nor dey good for yor eye, I go-go house back.”
34 Balaão disse ao anjo do Senhor: "Pequei. Não percebi que estavas parado no caminho para me impedires de prosseguir. Agora, se o que estou fazendo te desagrada, eu voltarei".
35 But God angel ansa, “Make yu go with di men, but na only wetin I tell yu, na-im yu go tok.” So Balaam kon go with di prince dem wey kom from Balak.
35 Então o anjo do Senhor disse a Balaão: "Vá com os homens, mas fale apenas o que eu lhe disser". Assim Balaão foi com os príncipes de Balaque.
36 Wen King Balak hear sey Balaam dey kom, e go outside go meet am for Moab town wey dey Arnon boundary for di aria.
36 Quando Balaque soube que Balaão estava chegando, foi ao seu encontro na cidade moabita da fronteira do Arnom, no limite do seu território.
37 Balak kon tell Balaam, “Why yu nor kom di first time wen dem kom koll yu? Yu tink sey I nor go fit pay yu?”
37 E Balaque disse a Balaão: "Não mandei chamá-lo urgentemente? Por que não veio? Acaso não tenho condições de recompensá-lo? "
38 Balaam ansa am, “Naw I don kom, but I nor get pawa to tok wetin I wont. Na only wetin God tell mi, I go tok.”
38 "Aqui estou! ", respondeu Balaão. "Mas, seria eu capaz de dizer alguma coisa? Direi somente o que Deus puser em minha boca".
39 So Balaam kon follow Balak go Kiriat-Huzot town,
39 Então Balaão foi com Balaque até Quiriate-Huzote.
40 where Balak for kill kattle and sheep kon give some meat to Balaam and di prince dem wey dey with am.
40 Balaque sacrificou bois e ovelhas, e deu parte da carne a Balaão e aos líderes que com ele estavam.
41 Den di next morning, Balak kon take Balaam go Bamot Baal where e go for fit si some Israel pipol from far.
41 Na manhã seguinte Balaque levou Balaão até o alto de Bamote-Baal, de onde viu uma parte do povo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?