Números 23

PCM

1 Balaam kon tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi, den bring seven melu and seven ram.”

2 So Balak do wetin Balaam tok. Balak and Balaam kon give one melu and one ram as ofrin for each altar.

3 Balaam tell Balak, “Make yu stand for here near yor burnt ofrin and I go-go pray and anytin wey God show mi, I go tell yu.” So only Balaam kon go on-top di hill.

4 God kom meet Balaam and Balaam sey, “I don build di seven altar and I don give one melu and one ram for each one.”

5 Den God tell Balaam, “Go back go meet Balak, tell am wetin I tell yu.”

6 So Balaam go meet Balak for where en stand (near en burnt ofrin), both en and all di prince dem for Moab.

7 Den Balaam profesai kon sey:

8 Na how I wont take curse

9 I dey si dem from where I stand on-top di rock;

10 Who go fit kount Jakob dust,

11 Den Balak tell Balaam, “Wetin yu do mi so? I sey make yu help mi curse my enemy, but yu kon dey bless dem!”

12 Balaam ansa, “Na only wetin God tell mi, I go fit tok.”

13 Balak kon tell am, “Abeg, follow mi go anoda place where yu go si some Israel pipol, den help mi curse dem from der.”

14 So Balak take Balaam go Zofim field, on-top Pisgah, where e for build seven altar kon give one melu and one ram for each of dem.

15 Balaam kon tell am, “Make yu stand near yor burnt ofrin and I go-go pray to God.”

16 God kom meet and tell Balaam, “Make yu go back go meet Balak kon tell am wetin I tell yu.”

17 Wen Balaam kom back, e si sey Balak still stand near di burnt ofrin, with di prince dem for Moab. So Balak ask, “Na wetin God tok?”

18 Balaam kon profesai,

19 God nor bi like man wey dey lie

20 E don kommand mi make I bless dem

21 Wahala nor go happen to Jakob shidren;

22 Na God take dem komot from Egypt;

23 Nobody fit curse Jakob shidren;

24 Israel pipol go bi like strong lion

25 Den Balak tell Balaam, “As yu nor gri curse Israel pipol, den make yu nor bless dem!”

26 But Balaam ansa, “I nor tell yu sey na wetin God tell mi, na-im I go do?”

27 Balak tell Balaam, “Abeg make yu kom; I go take yu go anoda place. May bi God go allow yu curse dem from der.”

28 So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness.

29 Den Balaam tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi kon bring seven melu and seven ram.”

30 So Balak do wetin Balaam tell am kon give one melu and one ram for each altar.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado