1 Dis na di message wey God give Nahum wey kom from Elkosh town and na about Nineveh pipol.
2 Oga God dey jealous well-well;
3 Oga God nor dey kwik vex,
4 God kommand di river and e kon dry wons;
5 For God present, mountins dey shake
6 Na who fit stand wen God dey vex?
7 Oga God dey good,
8 But E go use heavy rain take distroy en enemies finish
9 Wetin make una dey plan against God?
10 En enemies bi like dry shuku-shuku for bush.
11 Na who bi dat wiked pesin for Nineveh
12 So Israel pipol, dis na wetin God tok:
13 Naw, I go skata and distroy Assyria pipol
14 For Nineveh, God tok about Assyria pipol sey:
15 Si! One messenja dey from di mountin