1 E don finish for mi!
2 Betta pipol wey dey fear God,
3 Dia hand dey only like to do bad tins!
4 Even di pesin wey good pass among dem,
5 So make una nor trust anybody;
6 Bikos boy pikin go rijet en papa
7 But as for mi, I bilive sey God go kom help mi.
8 So my enemies, make una nor happy,
9 I go dey patient as God dey ponish mi,
10 Den my enemies go si sey God dey for my side
11 For dat day, dem go ribuild Israel town
12 Pipol go from difren land kom honor una;
13 But di land go still dey empty and dirty go full am,
14 Naw, my God, make Yu protet yor pipol
15 God sey,
16 All di nashons for di world go stand sopraiz
17 Just as snake dey creep kom out from whole,
18 E nor get anoda god like Yu;
19 Yes! Yu go sorry for yor pipol.
20 Just as Yu promise awa grand-grand papa,