1 I bi one pesin wey know wetin e mean
2 E don porshu mi
3 Evritime, na only mi
4 E don make my skin and flesh old
5 Na sofa and wahala
6 Even doh I neva die,
7 E don tie mi with shain like prisona
8 I kry well-well make E help mi,
9 E use big-big stones take block evriwhere wey I dey pass
10 To mi, E hide like bear or lion
11 E drag mi komot for road; tear mi to pieces
12 E set en arrow to take shot mi die
13 and naw, E don shot mi
14 I don turn pesin wey pipol dey laf
15 Na bitterness and sofa bi di food
16 E don use my face rub groun
17 I nor know wetin peace mean again
18 Den I kry kon sey, “I nor get respet again!
19 Wen ever I remember as I take sofa without house to sleep,
20 I nor go ever forget di time wen I take sofa;
21 Anytime I remember all dis tins,
22 God faithful love nor dey end!
23 Wi dey always trust Yu
24 I tell mysef sey, “Na only God I get,
25 God dey good to pipol wey trust
26 So e betta make wi sidan kwayet
27 And na naw wey wi still dey yong,
28 Make wi sidan kwayet
29 Make wi bow face groun,
30 Pesin wey dem slap for one side,
31 Bikos God nor go forget us forever.
32 Even doh sey E dey make us sofa naw,
33 God nor like to sofa pipol
34 So to dey opress pipol for dis world,
35 to shit pipol kon kollect wetin bi dia own,
36 and E know dey happy wen dem
37 So, na who fit tok make sometin happen,
38 Nor bi from God mout evritin from kom?
39 Den, why wi human being go dey komplain
40 Instead, make wi shek and test di tins
41 Make wi lift awa hand and heart
42 “Wi don sin and go against Yu
43 Yu don hide yorsef bikos Yu dey vex
44 Yu hide yorsef for di kloud,
45 Yu don make us bi like dirty rag
46 All awa enemies dey tok bad against us.
47 Wi dey fear, bikos wi dey trap;
48 Wota dey rush kom out from my eye,
49 I still dey kry well-well
50 until God go look from heaven
51 My heart heavy well-well
52 Pipol wey I nor do bad to,
53 Dem trow mi inside one pit
54 Dem dey pour wota put for my head
55 But from inside di deep pit,
56 Yu hear my kry for help wen I sey:
57 Yes! Wen I koll Yu,
58 Oga God, na Yu bi my lawyer,
59 Yu don si di bad-bad tins wey dem do mi.
60 Yu don si all dia plans to revensh mi.
61 Yu don hear all di wiked names wey dem dey koll mi
62 Evriday, my enemies dey tok
63 Si dem! Weda dem sidan or stand,
64 So Oga God, make Yu pay dem back for all di bad tins
65 Make Yu give dem sturbon and strong heart,
66 So as Yu dey vex,