Jeremias 50

PCM

1 God tok thru Profet Jeremaya about Babilon and en pipol. E tell am sey,

2 “Make yu go tell di nashons di good news!

3 Na from nort one nashon go kom attack and distroy Babilon.

4 God sey,

5 Dem go ask kon follow di road wey dem dey pass go Zion.

6 My pipol bi like sheep wey waka lost.

7 Evribody wey si dem, dey attack dem.

8 So Judah pipol, make una kwik-kwik komot from Babilon!

9 Bikos I dey bring many strong nashons from di nort

10 Dem go tif and karry evritin wey dey Babilon.

11 God sey,

12 But dem go disgrace una and shame go katch dis great town.

13 Afta I don vex ponish Babilon, nobody go stay der again.

14 All di sojas, make una ready to attack Babilon.

15 Make una shaut for war for evriwhere for di town!

16 Make una kill all di farmer wey dey plant for di town.

17 God sey,

18 Bikos of dis, just as I ponish Assyria king, na so

19 I go take Israel pipol go back to dia land.

20 Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again

21 God sey,

22 Dem go hear war nois for Babilon.

23 Before, Babilon pipol skata di whole world.

24 I set trap for Babilon and e katch dem,

25 I don open di place where I keep my swods and war tins put.

26 Make una from far kom attack Babilon!

27 Make una kill all dia sojas anyhow!

28 (Make una listin! Pipol wey nor get house

29 Tell di sojas make dem attack Babilon.

30 For dat day, dem go kill all di yong men for di town

31 God sey,

32 Nashon wey dey karry body up,

33 God wey dey mighty sey,

34 But di Pesin wey go save dem, dey strong.

35 God sey,

36 Dem go distroy en profets wey dey lie

37 Dem go distroy en horse and shariot.

38 Wahala go kom di land

39 E nor go tey before wild animals go kom take Babilon land

40 Just as e bi wen I distroy Sodom and Gomorrah with di oda towns,

41 Si, strong sojas dey kom from nort.

42 Dem karry dia bow and swod;

43 Babilon king go fear well-well wen e hear wetin en enemies tok.

44 Like lion wey kom out from bush near Jordan, na so too,

45 So make una listin to di plan

46 Wen Babilon fall, di eart go shake

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado