1 God sey,
2 I go send strenjas kom distroy Babilon
3 Dem nor go give Babilon sojas time to even shot arrow
4 Dem go wound kon fall die for all di street
5 Mi, God wey dey mighty, neva forget Israel and Judah pipol,
6 So, make una run komot Babilon town!
7 Babilon pipol bi like gold cup for my hand a
8 But na wons Babilon fall kon skata.
9 Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town,
10 God sey,
11 So God go use Media kings take distroy Babilon.
12 Make una give sign make dem go attack Babilon.
13 Una wey dey stay along Babilon river,
14 God wey dey mighty, don swear with ensef sey,
15 God make di eart with en pawa;
16 Wen E kommand, di wota on-top sky dey make nois
17 Wen pipol si dis tins, dem dey bi like fool
18 Dem dey yuzles and pipol dey use dem make yeye.
19 Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin
20 God sey,
21 I still use una take
22 Na so too, I use una take kill men and wimen;
23 I still use una take kill shepads and dia animals;
24 But naw, una go si as I go take pay Babilon pipol
25 Babilon! Yu bi like mountin wey distroy di whole world,
26 Di stone wey skata for una town,
27 Make una give dem sign to attack!
28 Prepare di nashons make dem go fight against Babilon pipol.
29 Di eart dey fear and shake,
30 Babilon sojas don stop to fight
31 Difren messenjas go run go tell Babilon king sey
32 Enemies don seize di river wey dem dey pass
33 E nor go tey before enemies go kut dem for groun
34 King Nebukadnezzar for Babilon don skata,
35 Zion pipol sey, ‘Just as Babilon pipol sofa us,
36 Dis na wetin God tell Jerusalem pipol:
37 Babilon go turn where dem dey trowey dirty put
38 En pipol go shaut like lion wey dey find food;
39 As dem dey hongry, I go prepare food,
40 I go karry dem
41 God tok about Babilon sey:
42 Di sea rush enter Babilon
43 Di town don turn where pipol dey fear to stay
44 I go ponish Bel wey bi Babilon god
45 So Israel pipol, make una run komot from der!
46 Make una nor fear or luz hope,
47 So di time dey kom wen I go deal with Babilon juju.
48 Den evritin wey dey heaven and eart go dey happy
49 Na Babilon kill many pipol for dis world.
50 God tell en pipol wey dey Babilon,
51 Di pipol sey, “Wi dey shame,
52 God sey,
53 Even if Babilon klimb go sky
54 God sey,
55 I go distroy Babilon and nobody go hear en vois again.
56 ‘Wi don distroy Babilon.
57 I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow.
58 Dem go distroy Babilon strong wall
59 Dis na di message wey Jeremaya give di senior offisa, Seraya wey Mahseaya pikin, Neraya born and na for di time wen e follow King Zedekaya go Babilon for di fourt year wey e bi king for Judah.
60 Evritin about di distroshon wey go happen to Babilon pipol and some oda tins about Babilon, I rite dem down for book.
61 Den I tell Seraya, “Wen yu rish Babilon, make sure sey yu read evritin wey I rite loud make evribody for hear yu.
62 Den make yu pray sey, ‘Oga God! Yu don sey Yu go distroy dis place and pipol or animals nor go stay der again and e go dey empty forever.’
63 Seraya, wen yu don read dis book finish for di pipol, tie am for stone and trow am inside Eufrates River kon
64 sey, ‘Dis na wetin go happen to Babilon. E go sink and e nor go raiz-up again, bikos of di way God go distroy am.’ ”