1 Dis na wetin God tok about Ammon pipol:
2 But di time dey kom wen I go make Rabbah pipol hear war nois,
3 Heshbon pipol, make una kry,
4 Ammon pipol! Why una nor dey faithful and dey boast?
5 I go make fear katch una from evriwhere
6 But afta, I go make Ammon prosper again.
7 Dis na wetin God wey mighty tok about Edom:
8 Dedan pipol, make una run go hide!
9 Wen pipol dey pick grape,
10 But I don naked Esau shidren-shidren finish
11 Shidren wey nor get papa and mama,
12 God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup!
13 I don swear sey Bozrah town go turn desert wey go dey make pipol fear; pipol go laf and use dem as curse. I go skata all di village wey dey around dem forever.
14 So I kon go meet and tell Edom pipol sey,
15 God go make una weak among oda nashon
16 Una pride don deceive una.
17 God sey,
18 Na di same tin wey happen to Sodom and Gomorrah,
19 “Like lion wey run kom from Jordan bush
20 So make yu listin to di plan wey I get for Edom pipol
21 Wen Edom fall, di nois go make di whole eart shake
22 Enemies go attack Bozrah land
23 Dis na wetin God tok about Damaskus:
24 Damaskus pipol don weak and dem kon run,
25 Di town wey full with happiness before,
26 For dat day, dem go kill all di yong men for di town
27 I go set fire for Damaskus wall
28 Dis na wetin God tok about Kedar and Hazor kingdom, wey King Nebukadnezzar for Babilon, win:
29 Make una seize dia tent, animals, curtain and evritin wey dey der.
30 Hazor pipol, mi wey bi God dey warn una sey
31 “Kom, make wi go attack doz pipol wey dey save and sikure!
32 So, I go take dia kamel and all dia animals!
33 Hazor go turn desert forever
34 Afta Zedekaya just bi king for Judah, God tok to mi about Elam town.
35 E sey,
36 I go make breeze blow against Elam from difren direcshon
37 I go make Elam pipol fear dia enemies.
38 I go distroy dia kings and leaders
39 But afta, I go make Elam pipol prosper again.