1 Dis na wetin God tok about Moab pipol:
2 Pipol nor go praiz Moab again.
3 Horonaim pipol dey kry sey,
4 Dem don distroy Moab!
5 Make una hear dia kry for di road wey dem dey pass go Luhit.
6 Dem sey, ‘Make una kwik-kwik run for una life!
7 Moab! Yu trust yor pawa and di many money wey yu get,
8 Doz wey dey distroy go distroy evry town.
9 So make una build grave for Moab,
10 (Pesin wey nor do God work with all en heart,
11 God sey, “Moab pipol dey always stay for peace
12 But di time dey kom wen I go send pipol go pour Moab pipol,
13 Den, just as Israel pipol shame for dia god for Bethel,
14 Moab men, why una dey bihave like sey una get pawa
15 Dem don distroy Moab town and all en pipol;
16 Di time wen dem go distroy Moab land don near
17 Una wey dey stay near dat nashon,
18 Yu wey dey stay for Dibon,
19 Yu wey dey stay Aroer,
20 Dem go ansa, ‘Moab don fall!
21 “Judgement don kom di towns wey dey up and dem bi: Holon, Jahza, Mefaat,
22 Dibon, Nebo, Bet-Diblataim,
23 Kiriataim, Bet-Gamul, Baal-Meon,
24 Keriot and Bozrah: judgement don kom meet di towns wey dey Moab: both di ones wey dey far and di ones wey dey near.
25 Dem don break and distroy Moab pipol pawa.
26 God sey, “Make Moab stagga kon fall like pesin wey don drink,
27 Moab pipol, hope una remember how una take laf Israel pipol?
28 Una wey dey Moab, make una komot from town
29 Moab pipol too dey proud!
30 Mi wey bi God, I know as dem dey karry body.
31 So, I go kry for doz
32 I go kry well-well for Sibmah and Jazer pipol.
33 Di happiness and joy wey dey Moab land,
34 Heshbon and Elealeh pipol kry well-well
35 I go stop Moab pipol make dem nor dey burn ofrin
36 So I dey kry from my heart for Moab and Kir-Heres pipol
37 All of dem don shave dia hair and barber dia bear-bear.
38 On-top Moab house and for di meetin place,
39 Moab don skata! Make una kry well-well,
40 God don promise sey, “One nashon go rush
41 and dem go seize di town and all en strong building.
42 Moab go skata and nobody go know am again,
43 Wahala, pit wey dem dig and trap wey dem set,
44 God still sey,
45 Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon,
46 Curse dey Moab land!
47 But di day dey kom wen God go make Moab prosper again.