1 God tell mi, “Go buy and wear one short nika wey dem make with linen and make yu nor wosh am.”
2 So, I kon go buy and wear am just as Oga God tok.
3 Den God tell mi again sey,
4 “Di short nika wey yu buy and wear so, pul and take am go Perat. Dig and hide am for one hole wey dey di rock near Eufrates River.”
5 So I kon go hide am for Perat just as Oga God tok.
6 Afta, God kon sey, “Go back go kollect di short nika for where yu beri and hide am put.”
7 So I go di place kon dig di nika kom out, but I notis sey di nika don skata and tear well-well.
8 Den God tell mi,
9 “Na so I go take distroy Judah and Jerusalem pipol pride.
10 Dis wiked pipol nor gri obey mi. Dem dey follow dia sturbon and wiked heart kon dey woship and serve oda gods. So dem go bi like dis nika wey nor get value again.
11 Just as nika fine and dey tight pesin for waist, na so I wont make Israel and Jerusalem pipol whole mi tight. So dat dem go bi my pipol wey go dey praiz and honor my name; but dem nor gri obey mi.”
12 Di Oga wey bi Israel God kon tell mi, “Jeremaya, if yu tell Israel pipol make dem pour wine full dia wine pot, dem go ansa yu, ‘Yes! Wi know sey wine suppose full awa pot.’
13 Den, yu go tell dem, ‘All di pipol wey dey dis land, God go give dem wine drink until di wine don katch dem: both di kings wey kom from David family, di priests, profets and all Jerusalem pipol.’
14 E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”
15 Den I tell Israel pipol,
16 Make una respet di Oga una God,
17 But as una nor gri listin,
18 God tell mi,
19 Enemies don surround Judah town wey dey sout
20 Jerusalem pipol, make una si,
21 Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink
22 And wen una ask, “Wetin make all dis tins
23 Black man fit shange en skin kolour,
24 So dat na why God go skata una
25 E sey dis na wetin go happen to una,
26 Na only God go tear una klot
27 Jerusalem pipol!