1 God tell Jeremaya:
2 “Make yu hear di kovenant wey I make with Israel pipol, den go tell Judah and Jerusalem pipol about am.
3 Tell dem sey, ‘Di Oga wey bi Israel God sey, “Curse go follow doz wey nor gri obey di kovenant.”
4 Wen I take Israel, my pipol komot from Egypt where di land bi like fire for dia body, na der I for make kovenant with dem. I tell dem make dem obey and do evritin wey I kommand. I still sey, if dem obey mi, dem go bi my pipol and I go bi dia God.
5 Den I go keep di promise wey I make with dia grand-grand papa kon give dem betta land. And na di land una dey today so.’ ” Den I sey, “Amen! My Oga God, make e bi as Yu tok!”
6 God tell mi, “Make yu go Judah town and Jerusalem street kon tell di pipol sey, ‘Make una listin and obey my kommand!’
7 Bikos, since I take una grand-grand papa komot from Egypt, I warn dem by mysef sey make dem obey mi and naw, I still dey warn una.
8 But dem nor gri listin or obey mi. Instead, dem dey do as dia sturbon and wiked heart tell dem. Na dis make mi curse dem, bikos of my kovenant and dem nor gri do wetin I kommand.”
9 Den God tell mi, “Judah and Jerusalem pipol dey plan against mi.
10 Dem don kontinue di wiked tins wey dia grand-grand papa dem do before, wey make dem nor obey my kommand. Demsef don dey woship oda gods. Both Israel and Judah pipol don break di kovenant wey I make with dia grand-grand papa.
11 So, mi wey bi God sey: ‘I go soon distroy dem and dem nor go fit eskape. I nor go listin to dem wen dem kry kom meet mi for help.’
12 Den, Judah and Jerusalem pipol go kry go meet di gods wey dem dey sakrifice to, so dat dem go kom help dem. But doz gods nor go fit save dem wen di wahala start.
13 Judah pipol gods plenty, just as di towns wey dem get. And as Jerusalem street plenty rish, na so too di altar wey dem build for Baal juju, plenty too.
14 So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”
15 God tell Judah pipol,
16 I don first koll una olive tree
17 Mi, God wey dey mighty,
18 God give mi sense
19 Before dis time,
20 So I pray to God:
21 Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”
22 So God wey dey mighty sey, “I go ponish dem! Dem go kill dia yong men for war and na honga go kill dia shidren.
23 I don choose di time wen I go bring dis wahala kom meet Anatot pipol and wen dat time rish, nobody among dem go survive.”