1 Den God tell Job:
2 “Yu dey argue with God Almighty;
3 Den Job ansa God:
4 “True-true, I dey tok like fool since,
5 I don tok pass wetin I suppose tok.
6 Den from inside di storm, God kon ansa Job:
7 Make yu stand strait
8 Yu dey try to sey I dey wiked,
9 Yu strong rish mi?
10 If na so, stand up make yu ansa mi;
11 Look pipol wey tink sey dem dey important,
12 Yes! Look dem, make yu bring dem
13 Beri all of dem for groun
14 Den na mi go first praiz yu
15 Si Behemot; I make am di way I make yu,
16 but si as en strent bi like lion own
17 En tail stand like tall tree
18 En bones strong like bronze
19 E dey among di tins wey God kreate wey dey sopraiz pipol!
20 Grass wey dem go chop,
21 E dey sleep for under tree wey valley wota dey pass
22 Inside bush dey gi-am betta place to rest.
23 E nor dey fear wota wey dey rush pass like river;
24 Who fit blind en eyes kom katch am?