Jó 39

PCM

1 Yu know how dem take born di goats

2 Yu know how long dem dey karry dia shidren for belle?

3 Yu know how dem take bend down

4 For inside forest dia pikin dey grow dey strong

5 Donkey wey dey forest, na who give dem freedom?

6 Na mi give dem di desert make dem stay.

7 Dem nor dey stay near di town at-all,

8 Na for mountin dem for dey si food chop,

9 How bush melu won take work for yu?

10 Yu fit use rope tie bush melu make e

11 Yu sure sey e go gri use en pawa

12 Yu dey espect am to bring wetin e harvest

13 Si as ostrich wey get long leg dey run,

14 E dey leave en egg for groun

15 E nor dey kare sey pesin leg fit mash di egg

16 E dey bihave like sey nor bi en get di egg

17 Na mi make am nor get sense like dat!

18 But wen e don start to run,

19 So Job, na yu make horse strong like dat

20 Na yu dey make dem jump like lokust

21 Dem dey skata groun as dem dey run for valley;

22 Dem nor know wetin fear mean

23 Di swod wey who dey ride dem karry,

24 Horse dey run go, bikos dem just dey happy anyhow;

25 As dem hear di trumpet dem go vex;

26 Hawk dey kom ask yu make yu tish am wisdom,

27 Abi eagle go wait for yor kommand

28 E build en house for di rock wey high pass

29 From dat place, e dey find sometin wey e go chop,

30 Eagle dey gada round dead body,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado