1 God kon ansa Job from inside di storm:
2 “Who yu bi to kweshon my wisdom
3 Naw, make yu stand like man
4 “Yu dey der wen I kreate di heavens and eart?
5 Na who tok how dem go big rish?
6 Na wetin hold di pilas
7 wen doz wey dey stay heaven
8 Who klose di sea mout wen e won
9 Na mi kover di sea with kloud
10 I give di sea where e go flow rish
11 I tell am sey, ‘Na here yu go rish and yu nor go pass der!
12 For yor life, yu don ever kommand morning
13 Abi yu don kommand day make e seize di eart
14 Na day lite make di hill
15 Day lite too brite for wiked pipol
16 Yu don rish where di wota wey dey full di sea dey?
17 Anybody don ever show yu di gate
18 Yu know how di world big rish?
19 Yu know where di lite from dey kom
20 Yu fit show dem how far dem fit go
21 I dey sure well-well sey yu fit,
22 Yu don ever go where I dey keep di snow
23 I keep dem dey wait di time wen trobol go kom
24 Yu don rish di place where sun from dey kom
25 Who dig pit for di rain wey dey fall
26 Who make di rain dey fall
27 Who dey wet di dry land with wota,
28 Abi di rain
29 Ice-blok and kold wey dey fall kom from di sky,
30 Wish time wota take strong like stone;
31 Yu fit luz di klot wey dey Orion waist
32 Yu fit guide di stars from one sizin to anoda
33 Yu know di law wey dey tell di sky wetin to do?
34 Yu fit kommand di kloud
35 If yu kommand lite make e flash,
36 Na who put wisdom for pesin heart
37 Who fit kount di kloud, bikos e feel sey e wise
38 rain wey dey make strong
39 Na yu dey give lion food make dem chop,
40 wen dem hide for dia hold
41 Na who dey feed raven bird wen dem dey waka dey find food for evriwhere?