1 Elifaz from Teman kon sey:
2 “Job! Abeg, make yu nor vex for wetin I won tok,
3 Si, yu don tish many pipol
4 Yor words don support pipol wey won fall
5 Naw wey e rish yor turn to face trobol,
6 Yu suppose get konfident and hope,
7 Make yu tink am sef,
8 But I don si and know sey,
9 God dey skata doz kind pipol,
10 Wiked pipol dey do like lion,
11 Dem go die like lion wey nor si food chop
12 My savant kom tell mi word small-small,
13 E kom tell mi like sey na dream
14 I fear and all my body kon dey shake.
15 Na small breeze blow my face
16 Sometin stand for der and even wen I look,
17 E get any man wey dey innocent before God?
18 If God nor even bilive en savants wey dey heaven;
19 yu tink sey E go bilive who E make from san;
20 Somebody fit dey alive for morning kon die for nite,
21 Dem go take evritin wey e get