Jó 3

PCM

1 As last, Job kon tok and e curse di day wey dem born am.

2 Job kon sey,

3 “Make di day wey my mama born mi disappear

4 Make di day turn to darkness.

5 Make darkness and deat shadow kover am!

6 Make dat nite komot from kalendar;

7 Make di nite empty

8 Make di pipol wey dey curse day, curse am!

9 Make en morning star remain darkness.

10 Make Yu curse di day wey my mama born mi,

11 “Wetin make mi nor die before my mama born mi?

12 Wetin make my mama karry mi for en lap?

13 If to sey I die dat time,

14 with kings and govnors

15 I for dey rest with prince wey get gold

16 Why dem nor beri mi like pikin wey die before dem born am?

17 Bikos for grave, wiked pipol nor fit do evil

18 Even di pesin wey dey prison before, dey rest,

19 Evribody dey der,

20 “Wetin make God dey give lite to pesin wey dey sofa?

21 Dem dey find deat, but dem nor dey si am;

22 Dem dey-dey happy

23 Wetin God give lite to doz wey nor get tumoro,

24 Instead make I chop, I dey kry

25 And naw, evritin wey I dey fear,

26 I nor get peace or rest

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado