1 Elihu still sey:
2 “Make yu relax and listin to mi small,
3 I go use wetin I know take show sey God dey rite.
4 My words nor bi lie;
5 True-true, God strong well-well!
6 E nor dey give wiked pipol long life,
7 E dey protet good pipol;
8 But if dem shain dem inside prison
9 God go show dem di rizin.
10 E go make dem listin to en warnin,
11 If dem hear God word kon serve am,
12 But if dem nor gri listin to God word,
13 Pipol wey nor know God go just dey vex
14 Dem dey die wen dem still yong
15 But God use sofa take dey tish
16 God remove yu from trobol
17 But naw, yu dey get di kind ponishment
18 Make yu dey kareful,
19 E nor go do yu any good sey yu dey kry for help;
20 Nor dey wait for nite,
21 Make yu dey kareful,
22 Make yu remember how God strong rish,
23 Nobody fit kommand God
24 Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do.
25 Evribody don si wetin E do!
26 “Wi nor fit know how God strong rish.
27 Na God dey take wota from di eart
28 E dey let di rain fall from di kloud,
29 Nobody know how tonda take dey make nois for di sky
30 E dey send lite pass di sky,
31 Dis na how E dey feed
32 Na en hand E take dey stop tonda lite
33 Even animals know sey tonda