1 So Job three friends nor gri ansa Job again, bikos dem know sey e dey tok trut.
2 Den Elihu wey bi Barakel pikin from Ram family for Buz kon dey vex. E dey vex, bikos Job sey e nor do God anytin.
3 E still vex for Job friends, bikos dem nor know how to ansa Job and evritin kon bi like sey, na God dey wrong.
4 Bikos na Elihu small pass for der, e wait until evribody tok finish.
5 Wen e si sey di three men nor fit ansa Job again, e kon dey vex.
6 Elihu wey en papa na Barakel wey kom from Buz kon sey:
7 I tell mysef sey make una tok,
8 But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter
9 Nor bi old age go make pesin wise
10 Naw, I won tok and una go listin to mi.
11 I kwayet dey listin to wetin una dey tok since;
12 I hear una well-well,
13 So why una dey tell pipol sey una get wisdom?
14 Job dey tok to una;
15 “Job, yor words too strong for all of dem;
16 Make I dey wait wen dem nor get anytin to tok?
17 But I go give yu my own ansa
18 I nor fit wait to tok
19 If una nor let mi tok,
20 I must tok make I dey free!
21 I nor go support one pesin for dis matter
22 I nor sabi praiz pesin anyhow,