1 “I don swear with my eye sey I
2 Wetin God for heaven choose for us?
3 Shebi trobol na for doz wey dey do bad tins
4 God know evritin wey I dey do;
5 I neva do wiked tin before
6 Make God just test mi weda I dey klean
7 If I don komot from di rite way;
8 den make anoda pesin chop wetin I plant.
9 If I dey like and won sleep with woman for my heart
10 den make my wife kook for anoda man chop
11 Bikos dat go bi big shame
12 Make e bi like hell-fire wey dey distroy tins;
13 If any of my savant komplain give mi,
14 If I nor dey do dem well, how I won take face God?
15 Na di same God wey kreate mi,
16 I dey always help poor pipol;
17 or allow shidren wey nor get papa and mama dey hongry,
18 Na since wen I small I don dey kare for doz wey
19 If I si pesin wey nor get at-all;
20 I go gi-am klot wey dem use my own animal wool take make.
21 If I don ever do bad to
22 den make my hand break.
23 But bikos I dey fear God ponishment,
24 I neva ever bilive money.
25 or kom dey karry body,
26 I neva ever woship sun,
27 I neva for one day like dem rish wen I go
28 Na deat dem take dey reward dat kind sin;
29 I neva happy wons, bikos my enemies dey sofa;
30 I neva ever pray make dem die,
31 My savants neva ever sey,
32 Doz wey dey travel, I dey koll dem enter my house
33 Oda pipol dey try to hide dia sin, but I neva ever hide my own.
34 I nor dey kwayet or stay for inside house,
35 “Nobody won listin to wetin I dey tok?
36 I go karry dem without shame for my shoulder
37 I go dey proud to tell God evritin wey I don do.
38 “If I tif di land wey I for dey farm
39 or chop di food wey grow for der,
40 den instead of fruit or korn to grow, make bush