1 “But pipol wey yong pass mi
2 Dem bi yuzles pipol
3 Bikos dem poor well-well and honga won kill dem,
4 Dem dey pul and chop plant for desert;
5 Evribody dey shaut follow dem like tif
6 Dem dey stay for inside hold wey en wota don dry
7 Dem dey bihave and shaut like animals
8 Dem nor get sense or name
9 “Naw, dem dey kom laf
10 Dem dey trit mi like sey I dey smell;
11 Bikos God don make mi weak and I nor get who go help mi;
12 Dem gada kon fight mi;
13 Dem follow mi as I dey run
14 Dem kon attack mi from difren angle.
15 Fear don chop my full body;
16 “I won die naw;
17 Di nite dey make my bones pain mi; di pains dey bite mi
18 God hold mi for neck with pawa
19 E trow mi for mud and naw,
20 God, I dey koll Yu,
21 Yu dey do mi anyhow;
22 Yu allow breeze blow mi go;
23 I know sey Yu dey karry mi go where I go for die;
24 “True-true, nobody go fight poor pesin,
25 Abi I nor follow pipol wey dey trobol kry
26 Na happiness and lite I dey hope for,
27 Pain and worry don skata my body;
28 I just dey waka for darkness and I nor dey si lite at-all.
29 I don kry sotey my vois don krack
30 My skin don black finish
31 I nor fit remember di last time wen I hear betta music,