1 Job still sey:
2 “If to sey my life go fit bi as e bi before
3 Dat time, God always dey with mi
4 Dat na di time wey evritin still dey well with mi.
5 Den God still dey with mi
6 My melu and goats dey give mi plenty milk
7 Wen ever di town eldas dey meet
8 yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom
9 Di leaders wey dey lead di pipol
10 Even di pesin wey dey important pass,
11 “Evribody wey hear from mi, dey praiz mi.
12 Wen poor pipol kry kom meet mi,
13 Doz wey dey face wahala, dey praiz mi
14 I dey always do betta tin.
15 Na mi bi blind pipol eye
16 I bi like papa to poor pipol
17 I dey distroy wiked pipol pawa
18 “Den I sey, I go get long life
19 I go bi like tree wey en rut get wota;
20 Evribody go dey praiz mi
21 “Wen I dey advise pipol,
22 and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish.
23 Evribody dey welkom mi,
24 I dey smile give dem wey nor bilive diasef again
25 I dey lead dem as king dey lead many pipol