1 Job still sey:
2 “As long as God Almighty wey nor gri judge my kase
3 as far I dey breath
4 my mout nor go ever tok bad
5 I nor go ever agri with wetin una dey tok!
6 I nor go ever give up, bikos I dey rite;
7 “Make all my enemies, sofa like wiked pipol
8 Doz wey nor know God before dem die,
9 Wen trobol go kom,
10 God go show dem en happiness?
11 Make I tish yu how God pawa strong rish.
12 But I nor go tish yu,
13 Zofar ansa,
14 If dia shidren many, dem go die for war
15 Di ones wey manage survive, na sickness go still kill dem
16 Wiked pipol fit get plenty money like san,
17 but na good pipol go wear dia klot
18 Wiked pipol dey build house like spider own
19 E go sleep as rish man,
20 Just as wota dey karry tins go, na so too fear go karry dem go
21 Strong wind from east go swip dem
22 and as dem dey try to run,
23 Strong breeze go push dem as dem dey run and with en pawa,