1 Job kon ansa:
2 “Today, my komplain still dey make my heart betta;
3 If to sey I know where I go for si God
4 I for komplain gi-am
5 I won know wetin E go tok
6 God go fight mi with all en pawa?
7 Since pesin wey dey rite with God fit go follow am tok,
8 I don find am go east, but I nor si am.
9 Wen God dey work for nort and sout,
10 Yet, God know evry step wey I dey take.
11 Bikos I just dey waka follow God for back;
12 I dey always do wetin E tok;
13 E neva shange and nobody fit oppoz
14 E go do wetin E don plan for mi.
15 Na dis make mi dey fear and wen ever I si am,
16 True-true, na God make mi dey fear.
17 Na God, nor bi di darkness make mi kwayet,