1 Job ansa:
2 “Make yu listin to wetin I dey tok.
3 Give mi shance make I tok and if I tok finish,
4 I dey komplain give human being?
5 Di way yu dey si mi naw dey sopraiz yu!
6 Wen I tink about wetin dey happen to mi,
7 “Why God dey let wiked pipol live?
8 Dem get shidren and grand-grand shidren
9 God nor dey send trobol go skata dia house;
10 All dia kattle dey get belle
11 Dia shidren dey run and play like animal pikin
12 Dem dey dance, dey play sheke-sheke,
13 Dem dey live dia life for peace
14 Dem dey tell God sey
15 Dem sey ‘Who bi dis God sef?
16 Dem tink sey na dia pawa dem take get evritin wey dem get,
17 “Dem don ever kwensh di lite wey wiked pipol get?
18 How many times dem bi like leaf wey breeze blow trowey
19 Yu dey sey, ‘God go ponish pikin for di sin wey en papa kommit!’
20 Make who sin karry di trobol by ensef;
21 Bikos wen pesin die,
22 Anybody fit tish God,
23 “Some pipol nor sick at-all until di day wen dem die;
24 Dia body dey shine well-well
25 Odas nor get happiness at-all;
26 But evribody must die.
27 “Yes! I know wetin yu dey tink.
28 Yu go soon tell mi about rish
29 Abi yu neva tok to pipol wey travel before?
30 Di day wey God go vex ponish pipol,
31 E nor get who fit blame wiked pipol
32 Dem go guide di grave wey dem beri
33 Pipol go many for dia burial
34 So how yor bad words won take konfort mi