1 Job ansa:
2 “I don hear many words like dis before.
3 All dis yeye word wey yu dey tok neva taya yu?
4 If na yu dey face wetin I dey face so;
5 But fit to sey na mi I for enkourage yu.
6 “But e nor get wetin I go tok give yu,
7 My Oga God, true-true, Yu don kill my full family
8 Yu don seize and turn mi to yor enemy.
9 God don skata mi, bikos E dey vex.
10 Pipol dey curse and laf mi.
11 God don karry mi give wiked pipol.
12 I dey live for peace before,
13 E dey shot mi with en arrow from difren direcshon.
14 E wound mi many times.
15 I dey mourn with sak klot
16 I kry sotey my eyes don dey red
17 I dey pray to God from my heart,
18 “Dis groun, na beg I dey beg yu,
19 I know sey pesin dey for heaven
20 My friends dey tok against mi
21 Abeg, I nid pesin wey go help mi beg God,
22 My years nor plenty again