1 Den Elifaz wey kom from Teman kon tell Job:
2 “Pesin wey get sense dey tok anyhow?
3 No wise pesin go tok as yu dey tok so
4 Yu nor dey fear God?
5 Na yor sin dey kontrol yor mout
6 E nor get any nid for mi to kondemn yu;
7 Na yu bi di first man wey dem born?
8 Yu dey hear di plans wey God dey make?
9 Wetin yu tink sey yu know wey wi nor know?
10 Wi learn and get awa sense from old pipol;
11 God konfort too small for yu?
12 Wetin make yu nor dey rizin well again?
13 sotey yu dey tok all dis kind words,
14 Any human being fit dey klean?
15 God nor even bilive en own angels,
16 how E won take bilive man wey dey drink bad
17 If yu go gri listin, I go esplain give yu.
18 Pipol wey get sense don tish mi trut
19 doz wey God give di land
20 Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart.
21 Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear
22 Dem nor get hope to kom out from darkness,
23 Dem dey waka anyhow dey find food.
24 Just like wen strong king dey wait to attack en enemies,
25 bikos dem dey tok to God anyhow,
26 Dem hold dia strong swod
27 Dis wiked pipol big and dem dey prosper;
28 But dia towns go skata.
29 Dia money nor go tey for dia hand
30 Dem nor go fit run from darkness;
31 If dem nor get sense rish
32 Dem go die finish before dia time go rish den dia branches
33 Dem go bi like tree wey dem kwik plok en fruits;
34 Doz wey nor dey fear God nor go get anytin at-all
35 Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”