1 “True-true, my eyes don si all dis tins,
2 Wetin yu know, I know am too.
3 But I wish sey I fit tok to God, nor bi yu.
4 Yu bi oga for lie-lie;
5 If to sey yu just kwayet,
6 So naw make yu listin to my words;
7 Yu won use lie defend God?
8 Abi yu dey try to tok for am?
9 If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body?
10 Even if yu dey pritend sey yu dey sorry for mi,
11 Abi en pawa nor go make yu fear?
12 Di words wey yu dey tok nor dey good at-all,
13 Make yu shut up yor mout,
14 Why I dey risk my life like dis?
15 Even if E kill mi, I go still dey bilive am;
16 E fit bi sey my boldness fit save mi,
17 Naw, make yu listin to wetin I dey try to tok;
18 I don dey ready to komplain gi-am,
19 Anybody fit argue with mi for dis matter?
20 Abeg make I ask for two tins and make Yu do dem for mi,
21 Make Yu remove yor hand from my life
22 God, make Yu koll mi and I go ansa or make I tok,
23 Wish kind sin I kommit sef?
24 Why Yu dey hide from mi?
25 Na ordinary leaf wey breeze dey blow Yu won fight?
26 Yu just dey rite bad tins against mi;
27 Yu don put big shain for my leg and evriwhere wey I waka go,
28 Naw, I don turn rotin wood