1 Den Job ansa:
2 “True-true, una know pass evribody.
3 But I get sense as yu get too.
4 Even my friends dey laf mi naw;
5 Yu nor get trobol,
6 But tif and pipol wey nor dey fear God dey live for peace,
7 “Even bird and animals get many tins
8 Make yu ask di eart
9 All of dem know sey na God by ensef dey
10 bikos na God hand dey hold di eart
11 But as yor tongue dey taste food,
12 Old pipol get wisdom?
13 But God get wisdom and pawa.
14 Wen God skata,
15 Evriwhere go dry if God sey make rain nor fall
16 Na God get strent and wisdom;
17 E dey make leaders bihave like fools
18 E dey remove kings from dia throne
19 E dey honbol priests
20 E take di wisdom wey old pipol get
21 E disgrace princess
22 E open all di sekret tins wey dem hide for darkness
23 Na-im dey give nashons pawa
24 E make leaders bi like fools
25 Dem dey waka find road for darkness.