1 Zofar wey kom from Naamah kon tell Job:
2 “So nobody won ansa all dis nonsense wey yu dey tok?
3 Yu feel sey yu words nor go make mi tok?
4 Yu sey, ‘My tishing dey pure
5 But I wish sey God go just ansa
6 E go show yu sey wisdom get many side.
7 Yu fit find out where God from kom?
8 God high pass di heavens;
9 God big pass di eart
10 If God arrest and put pesin for prison or karry am go kourt,
11 God know pipol wey dey lie;
12 Pesin wey nor get sense,
13 But for yu Job!
14 If yu dey hide do wiked and bad tins,
15 Na dat time yu go fit face di world without fear
16 Dat time all yor trobols go vanish
17 Yor life go shine pass aftanoon sun
18 Bikos wi get hope, yor life go dey well;
19 Yu nor go fear yor enemies again
20 But wiked pipol eye go blind