1 “For dat time, wen I don make Judah and Jerusalem prosper again,
2 I go gada and judge di pipol for Jehoshafat Valley,
3 Dem trow dice take divide
4 Tyre, Sidon and Filistia pipol,
5 Una take my gold and silva
6 Una sell Judah and Jerusalem pipol
7 But I go bring dem kom back from where una sell dem go.
8 I go make dem sell una shidren give Judah pipol;
9 So make una tell pipol for difren kountry sey:
10 Make una do una swod well
11 All di nashons wey dey round una,
12 Di pipol must ready kom Jehoshafat Valley.
13 Dem wiked well-well
14 Plenty-plenty pipol dey Judgement Valley.
15 Di sun and moon don dark
16 God vois bi like lion own from Mount Zion;
17 “Den, Israel pipol, una go know
18 For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins
19 But Egypt land go bi desert
20 But pipol go full Judah land forever
21 My pipol wey I neva forgive before,