1 “Na who go bilive di message wey wi dey hear naw?
2 My savant grow like seed wey dem plant for dry groun.
3 Pipol rijet am and dem nor like am at-all.
4 But E bear di sofa and pain wey suppose bi awa own.
5 But dem wound am bikos of awa sin;
6 All of us bi like sheep wey don lost
7 Dem trit and ponish am anyhow,
8 Dem arrest and sey make dem kill-am
9 Even doh e nor do any bad tin or tok lie,
10 Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice,
11 But wen e si all di good tins wey en sofa bring,
12 So, I go honor and put am for where great men dey,