1 God sey, “Una wey dey for far land,
2 Na who raiz di raitious Pesin kom from east
3 E porshu and pass dem and e nor wound at-all.
4 So, na who do all dis tins? Na who tok how generashon go bi?
5 Pipol from far place si wetin I do and fear katch dem;
6 Dem dey enkourage and tell each oda sey,
7 Di karpenters among dem dey enkourage doz wey dey make gold
8 “But Israel na my savant!
9 pipol wey I koll and bring back from where di world for end kon sey,
10 So make una nor fear, bikos I dey with una!
11 Pipol wey dey vex with una,
12 and dem go disappear komot from dis eart.
13 Na mi bi di Oga wey bi una God
14 God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish,
15 I go make una bi like new swod wey get sharp korna.
16 Una go blow dem and breeze go skata
17 Wen poor pipol and doz wey dem dey opress dey look for wota
18 I go make river flow from dry hill and wota go flow for valley.
19 I go make cedar, akacia, myrtle and olive trees grow for di desert.
20 Pipol go si dis tins and dem go know sey,
21 God wey bi Israel pipol king sey:
22 Make una tell us wetin go happen,
23 Make una tell us how di future go bi,
24 Una with evritin wey una dey do, nor mean anytin.
25 I don choose one pesin from east,
26 Make wi know who tok am before e happen,
27 Na mi God first tell Zion sey,
28 Wen I look all di gods, no one get anytin to tok;
29 All dis gods dey yuzles; dem nor fit do anytin at-all.