1 Pipol from evry nashon,
2 God dey vex for all di nashons and dia sojas.
3 Nobody go beri dem; dem go rotin for groun.
4 All di stars go vanish komot, di sky go disappear like book wey dem klose
5 God dey ready with en swod for heaven and E go kut Edom;
6 Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb,
7 God go kill dem with all dia animals.
8 God don plan di day wey E go revensh Edom pipol
9 Edom rivers go turn black like shako and di land go turn to sulfur.
10 E go dey burn both for day and nite and smoke go dey
11 Na owls and ravens go dey stay di land.
12 En kings and leaders nor go get anywhere to koll dia kingdom again
13 Shuku-shuku go grow full dia farms;
14 Na for der doz animals for desert go dey do meetin;
15 Wiked bird go build dia house, lay eggs,
16 So make una take time take read God book!
17 Na God go divide di land give dem