1 Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die,
2 So my God, make Yu sorry for us,
3 Wen Yu fight for us,
4 Awa enemies propaty dey skata
5 God dey great well-well!
6 Na-im dey make en pipol strong
7 Si, pipol wey dey ripresent kountries dey kry
8 Di main road dey empty,
9 Di land don dry and nor-tin dey inside again.
10 God tell di nashons sey, “Naw, I go get up!
11 Una just dey make yeye plans
12 Una go skata like rocks wey dem dey burn take make lime;
13 So make evribody wey dey near and far hear wetin I don do,
14 Zion pipol wey dey sin, dey fear!
15 Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite;
16 na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well.
17 E nor go tey again before una go si one good king wey dey rule well
18 Una go remember all di wahala wey una face before,
19 Una nor go ever si sturbon pipol
20 Instead, una go si Zion,
21 True-true, God go rule for der as awa king.
22 Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king,
23 For dis time, all awa enemies ship rope don slak;
24 Nobody for Zion go sey, “I know well or I dey sick”,