1 Pipol wey dey go Egypt for help,
2 God wise well-well! E dey do just as E tok.
3 Egypt pipol nor bi god!
4 True-true, dis na wetin God tell mi,
5 Just as bird dey fly round en house make e for protet en shidren,
6 God sey, “Israel pipol, una don sin and oppoz mi, but make una turn from sin kom meet mi!
7 Bikos I know sey di time go kom wen all of una go trowey di juju wey una use gold and silva take make.
8 “Dem go kill Assyria pipol with swod for war
9 Dia king go run komot from en palis bikos of fear;